- Sweet Mother Sweet mother I no go forget you for the suffer wey you suffer for me. Sweet mother I no go forget you for the suffer wey you suffer for me. When I dey cry, my mother go carry meshe go say, my pikin, wetin you dey cry ye, ye, stop stop, stop stop make you no cry again oh. When I won sleep, my mother go pet me, she go lie me well well for bed, she cover me cloth, sing me to sleep, sleep sleep my pikin oh. When I dey hungry, my mother go run up and down. she go find me something when I go chop oh. Sweet mother I no go forget you for the suffer wey you suffer for me When I dey sick, my mother go cry, cry, cry, she go say instead when I go die make she die. O, she go beg God, God help me, God help, my pikin oh. If I no sleep, my mother no go sleep, if I no chop, my mother no go chop, she no dey tire oh. Sweet mother I no go forget you, for the suffer wey you suffer for me. You fit get another wife, you fit get another husband, but you fit get another mother? No! And if I forget you, therefore I forget my life and the air I breathe. And then on to you men, forget, verily, forget your mother, for if you forget your mother youve lost your life.
News, Lifestyle, Entertainment, Education, Religion, Culture, Science, World, Motivation, Nature, Knowledge, Intelligence, Inspiration, Wisdom & Love
Saturday, 9 March 2013
Video: SWEET MOTHER - PRINCE NICO MBARGA WITH LYRICS.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment