Lagos State Government bin inaugurate 8-man Judicial Panel of Inquiry and Restitution to torchlight cases of police brutality for di state as sake of di end SARS protest wey youths stage for over two weeks to demand justice for extra-judicial killings by di police and reforms of di institution.
The Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, say Section 5 of Tribunals of Inquiry Law, Laws of Lagos State, 2015 give am right to set up di panel and add say two young pipo go dey inside.
Di sitting go start on Tuesday, 27, October 2020.

